Saturday, May 23, 2026
  • Home
  • Politics
  • News
  • Business
  • Culture
  • National
  • Sports
  • Lifestyle
  • Travel
  • Opinion
PeriscopeNGA.com
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Culture
  • Opinion
  • Lifestyle
  • Contact
No Result
View All Result
PeriscopeNGA.com
Home Opinion

Humpty dumpty by Ejalonibu Amodu

Uche Bende by Uche Bende
October 20, 2024
in Opinion, Opinion/Letter
0
Humpty dumpty by Ejalonibu Amodu
1k
VIEWS
Share on FacebookShare on Twitter

As money dey show,
And life dey sweet small small,
And as my own dey better pass my neighbour own,
Na so I call oga bricklayer make e
come help me build wall.
I say “fence de house round,
block everywhere,
Make you make sure sey e tall well well!”

Na so block dey climb block every day
for three months,
until even breeze sef no see space
to shake body.
My neighbour stand, him pikin sef dey look,
Dem mouth quiet but dem eye dey talk,
Like sey dem sabi wetin go still happen

Related posts

Old Oyo park and the philosophy of Ogboju Ode ninu Igbo Irunmole, by Citizen Bolaji O. Akinyemi

Old Oyo park and the philosophy of Ogboju Ode ninu Igbo Irunmole, by Citizen Bolaji O. Akinyemi

May 20, 2026
1k
Soun, where is Ogbori Elemoso? Part 1, by Citizen Bolaji O. Akinyemi

Soun, where is Ogbori Elemoso? Part 1, by Citizen Bolaji O. Akinyemi

May 19, 2026
1k

As dem build my fence finish,
I like am well well,
Until Humpty Dumpty go siddon on top.
Wall no gree, e fall yakata for ground—
E scatter my ride,
E even almost catch me inside!

Glass shatter for ground,
I vex, but wetin vex go do?
Mechanic laugh my car tire,
bricklayer confuse,
Me, I just sidon, dey tink wetin I dey do.

Why I need wall wey no go let my
children fit play as dem like?
Why I build fence when joy dey
waka free from one house to anoda house?
E nor need knock.

So I tell oga bricklayer, “No build am back.
Clear all the blocks,
make breeze see road pass.”
Life suppose simple,
why we like to dey make am hard?
Pikin dem dey play, no border, no visa.
But no wall to fall, no wahala at all.
And Baba Humpty?
Dat one don disappear!

Tags: by Ejalonibu AmoduHumpty dumpty
Previous Post

Northern govs donate N900m to support Jigawa tanker explosion victims

Next Post

De people wey normal 

Next Post
Humpty dumpty by Ejalonibu Amodu

De people wey normal 

BROWSE BY CATEGORIES

  • Advertorial
  • Agriculture
  • Appointment
  • Business
  • Columns
  • Covid-19
  • Crime
  • Culture
  • Development
  • Education
  • Family Planning
  • Features
  • Finding Purpose with Oluwatimileyin
  • Health
  • Interview
  • Investigation
  • Keeping It Real With Nneka
  • Lifestyle
  • Malnutrition
  • National
  • News
  • News
  • NYSC
  • Opinion
  • Opinion/Letter
  • Pillow Talks With Keziah
  • Politics
  • Responsible Parenting with Oluwatobi Akintola
  • Sport
  • Sports
  • Technology
  • Travel
  • Water, Sanitation and Hygiene

BROWSE BY TOPICS

#Gombe 000 2022 2023 2027 Abia Abuja Adamawa Again Apc Bauchi by Austen Akhagbeme by Ben Ngwakwe by Citizen Bolaji O. Akinyemi By Douglas Ogbankwa by Erasmus Ikhide by Hassan Gimba by Tony Erha Campaign CBN Commissioner Edo 2024 ekiti state FG Gombe Gombe Gov Gombe State Gov Yahaya Group Inec insecurity Kaltungo Mailantarki nigeria NNPP North-East NYSC others Pdp Police Qatar Taraba Tinubu USAID women
  • About
  • Advertise
  • Careers
  • Contact

© 2023 PeriscopeNGA.com - Periscope Nigeria | Website by Sociopact.

No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • News
  • Business
  • Culture
  • National
  • Sports
  • Lifestyle
  • Travel
  • Opinion

© 2023 PeriscopeNGA.com - Periscope Nigeria | Website by Sociopact.

Jojobet GirişJojobet GirişholiganbetMadridbetJojobet GirişHoliganbet Girişdeneme bonusu veren sitelerCasibom