Dem call me winch
Sake of say I try defend myself
Dem say I no be beta christian
Becos I no gree turn my other cheek
Dem say winch dey my body becos I no gree die
Dem say wife material no suppose dey do gragra
I suppose for chop slap and cane without complain
I hear say I don become him property becos him pay dowry
Dem say becos I defend my sef from him
I don dey do juju
Dem con tell me say I go go wash my head for the village river
But dem forget say I come from the lineage of Oya
The powerful goddess of water and storm
Dem no know say to carry me for the river be like to carry me go house
My husband call me winch
Becos when him carry knife, I carry cutlass
Him come tell him kinsmen say I be Mami water
Becos I try to defend mysef
That one na five years ago
Now, when Dem call me winch, I dey answer well well
I carry the name for head like gele
Weary am for body like Iro and buba
I carry am for my shoulder like handbag
Yes, I be winch
Because I no let Dem kill me as Dem been kill the rest wey come before me



