You tink sey na only human being dey drink ogogoro abi?
You never see anytin!
You no know sey country sef dey drink?
Yes, country!
If you never see dat kind tin for your life,
spread world map for table,
make you on light make e bright well well,
come carry glass look for map.
You go see one country wey siddon, tie wrapper,
dey drink kai kai wit tooth pick for mouth.
If you tey well well for there,
You go see am dey stagger
like sey ground hot.
And no be only for map o!
For 1969, when oyinbo dem go for on top moon,
Dem sey when dem from there look our planet,
All de other country dem siddon wella.
Na only one country dey stagger like drunken master.
“Money is not our problem, but how to spend it”
Small money wey my country get, im take am go drink.
We dey try follow am talk yesterday night.
Im say: If una won abuse me today make una put respect o,
because today no be kai kai I take, na Star I drink.
Just imagine.



