We plenty wey dey sell zobo
for Nigeria.
Make we start wit our
papa and mama—na for their hand
we first taste zobo.
Our priests sef dey sell.
Any kind priest o,
whether for church, for mosque,
abi for shrine—all of dem dey sell am. In fact,
na their own Nigerians dey drink pass.
Politicians? Ahhhh! Na their zobo dey plenty pass.
Dem dey add jara and fisi on top am.
Everybody fit buy their zobo.
Dem fit even dash you sef.
All dis performers wey we dey watch for
phone and television,
Na their zobo na im sweet pass.
If you drink am,
e go just enter your brain selele one time!
Professors and poets nko? Their own sef dey.
Dem dey mix am wit many many spices.
But na only big man fit buy dis kind zobo.
Dem no dey sell am for Oyingbo market.
Make I nor lie, even me sef,
I never taste dat one.
But de one wey surprise my tongue pass
Na de zobo wey I taste for police station today.
Chai!
After OC give me zobo drink,
I begin cry like pikin wey dem beat.
De zobo sweet ehn, my body dey shake
like sey I sick.
I nor know when I carry my property go sell,
dash OC de money



