Friday, September 4, 2026
  • Home
  • Politics
  • News
  • Business
  • Culture
  • National
  • Sports
  • Lifestyle
  • Travel
  • Opinion
PeriscopeNGA.com
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Culture
  • Opinion
  • Lifestyle
  • Contact
No Result
View All Result
PeriscopeNGA.com
Home Opinion

“Vigilante!” by Otuke

Danladi Bako by Danladi Bako
July 13, 2024
in Opinion
0
“Vigilante!” by Otuke
1k
VIEWS
Share on FacebookShare on Twitter

Related posts

Revealed: Real reason Benue Assembly ordered suspension of ongoing teachers recruitment, summoned SUBEB chairman 

A call for justice, inclusive governance and equal belonging in Benue State, by Dr Paul Ede Agbo  

September 4, 2026
1k
PDP NWC suspends South-South vice chairman, lauds support for Ighodalo

The lion of the opposition: Remembering Chief Dan Osi Orbih’s indomitable legacy, by Erasmus Ikhide

September 4, 2026
1k

01
Vigilante! Vigilante!
All de sleep wey una don dey sleep never do?
E never reach una time to wake?

I say ma tell una sey 
night don reach us o
Light don waka commot o
Everywhere don dark o
We no dey see road again o

I say ma tell una sey
de light wey una promise us no reach us o
de torchlight no reach us o
de lantern sef no reach us o

De people wey una swear sey una go guide
don waka inside koto finish o
Dem no dey see road again o
All of dem don begin dey waste troway
Like food wey dog chop remain.

Vigilante! Vigilante!
How many times I call una?
rat no dey cry like rat again o
Rat don dey cry like fowl

Vigilante! Vigilante!
Fowl no dey cry like fowl again o
Fowl don dey cry like rat

Everywhere don mess
Everywhere don vex
Everywhere don scatter

02
Vigilante! Vigilante!
All de sleep wey una don dey sleep never do?
E never reach una time to wake?

I say ma tell una say 
Lion don break fence o
All de sheep don die finish o
Everywhere don red o
We no dey see white again o

I say make I tell una say 
de better fence wey una promise us no reach us o
De blanket no reach us o
De alarm no reach us o

All de sheep wey una swear sey una go guide
No be dia body na im lion dey chop so?
Na one eye dem take dey sleep for night o
All of dem don begin dey waste troway
Like water wey dem take wash cloth

Vigilante! Vigilante!
How many times I call una?
rat no dey cry like rat again o
Rat don dey cry like fowl

Vigilante! Vigilante!
Fowl no dey cry like fowl again o
Fowl don dey cry like rat

Everywhere don mess
Everywhere don vex
Everywhere don scatter

Tags: by OtukeVigilante
Previous Post

“Everybody just dey craze dey go” by Otuke

Next Post

Edo 2024: All eyes on Ighodalo

Next Post
Edo 2024: All eyes on Ighodalo

Edo 2024: All eyes on Ighodalo

BROWSE BY CATEGORIES

  • Advertorial
  • Agriculture
  • Appointment
  • Business
  • Columns
  • Covid-19
  • Crime
  • Culture
  • Development
  • Education
  • Family Planning
  • Features
  • Finding Purpose with Oluwatimileyin
  • Health
  • Interview
  • Investigation
  • Keeping It Real With Nneka
  • Lifestyle
  • Malnutrition
  • National
  • News
  • News
  • NYSC
  • Opinion
  • Opinion/Letter
  • Pillow Talks With Keziah
  • Politics
  • Responsible Parenting with Oluwatobi Akintola
  • Sport
  • Sports
  • Technology
  • Travel
  • Water, Sanitation and Hygiene

BROWSE BY TOPICS

#Gombe 000 2022 2023 2027 Abia Abuja Adamawa Again Apc Bauchi by Austen Akhagbeme by Ben Ngwakwe by Citizen Bolaji O. Akinyemi by Cliff Stanley by Destiny O. Enabulele By Douglas Ogbankwa by Erasmus Ikhide by Hassan Gimba by Tony Erha Campaign CBN Commissioner Edo 2024 ekiti state FG Gombe Gombe Gov Gombe State Gov Yahaya Inec insecurity Mailantarki nigeria NNPP North-East NYSC others Pdp Police Qatar Taraba Tinubu USAID women
  • About
  • Advertise
  • Careers
  • Contact

© 2023 PeriscopeNGA.com - Periscope Nigeria | Website by Sociopact.

No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • News
  • Business
  • Culture
  • National
  • Sports
  • Lifestyle
  • Travel
  • Opinion

© 2023 PeriscopeNGA.com - Periscope Nigeria | Website by Sociopact.