Tuesday, June 30, 2026
  • Home
  • Politics
  • News
  • Business
  • Culture
  • National
  • Sports
  • Lifestyle
  • Travel
  • Opinion
PeriscopeNGA.com
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Culture
  • Opinion
  • Lifestyle
  • Contact
No Result
View All Result
PeriscopeNGA.com
Home Opinion

“Everybody just dey craze dey go” by Otuke

Auwal Gombe by Auwal Gombe
July 13, 2024
in Opinion
0
“Everybody just dey craze dey go” by Otuke
1k
VIEWS
Share on FacebookShare on Twitter

Related posts

The second half advantage: Finishing strong through purpose, impact and legacy, by Cliff Stanley 

The second half advantage: Finishing strong through purpose, impact and legacy, by Cliff Stanley 

June 29, 2026
1k
The travails of a legal icon: The Mike Ozekhome story, by Erasmus Ikhide

The travails of a legal icon: The Mike Ozekhome story, by Erasmus Ikhide

June 29, 2026
1k

Anytime wey I look dis country wey we dey so
Im just dey resemble gutter for my eye
Dis country con be like de skin of dead body
wey don die for like ten days
Maggot everywhere, fly everywhere
Wey be sey, to look sef dey do me make I vomit
Everywhere wey I turn go
Everywhere wey I look
Roti-roti do full am

Everyday, innocent people dey die like fly
Everyday, Innocent dey die put for prison
For crime wey dem no commit
Everyday wicked people dey enjoy
 harvest anyhow for where dem no plant

All our mind don be like rock finish
We don see dead body tire
We don suffer tire
E no even move us again
Our young people na im I fear pass
Most of dem don spoil finish
TikTok con be like Ogogoro, 
Instagram con be be like Igbo
Im be like loud, dem just dey high dey go
dem no fit stop.
On top all dat one? 
Dem no dey read book again
Dem con stubborn join, like he-goat
Sometimes, e dey do me make I
Carry slap, give dem for head
Make dia brain for reset
But, I no want wahala

I don reason am so tey,
But, nothing wey I fit do
Na look I just dey look dis country
Like spirit we come Im own funeral
I dey look as everything take dey roti
But I no fit do anything to stop am
Even if I try sef, where I for wan take start?

E get one man, im name na Albert Einstein
e don kpai now, but for when im dey alive
im tok say “person wey no gree change Im bad ways, 
wey no gree change de bad-bad things wey Im dey do
Wey con dey expect sey good-good things 
go thing go dey come im way?” 
Im tok sey dat person dey craze, 
in fact, dat person own worse 
pas person way dey craze

Anytime wey I look this country wey we dey so
Im just dey resemble gutter everyday
E con be like say na only me get eye 
De thing wey dey kill us 
All of us carry dat one put for head
De one way go save us, wey go move us forward 
We dispose am. Carry am troway
As e be so, if dis country like, make e kpai
I don see sey e no concern most of us
Na to come, chop national cake, clean mouth
Na to oppress people wey no fit defend demsef
Na to wicked our neighbor, na Im we know
Free sense full everywhere, but dat one no too concern us
Everybody just dey craze dey go.

Tags: "Everybody just dey craze dey go"by Otuke
Previous Post

“Taink God sey dem change our National Anthem” by Ejalonibu

Next Post

“Vigilante!” by Otuke

Next Post
“Vigilante!” by Otuke

"Vigilante!" by Otuke

BROWSE BY CATEGORIES

  • Advertorial
  • Agriculture
  • Appointment
  • Business
  • Columns
  • Covid-19
  • Crime
  • Culture
  • Development
  • Education
  • Family Planning
  • Features
  • Finding Purpose with Oluwatimileyin
  • Health
  • Interview
  • Investigation
  • Keeping It Real With Nneka
  • Lifestyle
  • Malnutrition
  • National
  • News
  • News
  • NYSC
  • Opinion
  • Opinion/Letter
  • Pillow Talks With Keziah
  • Politics
  • Responsible Parenting with Oluwatobi Akintola
  • Sport
  • Sports
  • Technology
  • Travel
  • Water, Sanitation and Hygiene

BROWSE BY TOPICS

#Gombe 000 2022 2023 2027 Abia Abuja Adamawa Again Apc Bauchi by Austen Akhagbeme by Ben Ngwakwe by Citizen Bolaji O. Akinyemi By Douglas Ogbankwa by Erasmus Ikhide by Hassan Gimba by Tony Erha Campaign CBN Commissioner Edo 2024 ekiti state FG Gombe Gombe Gov Gombe State Gov Yahaya Group Inec insecurity Kaltungo Mailantarki nigeria NNPP North-East NYSC others Pdp Police Qatar Taraba Tinubu USAID women
  • About
  • Advertise
  • Careers
  • Contact

© 2023 PeriscopeNGA.com - Periscope Nigeria | Website by Sociopact.

No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • News
  • Business
  • Culture
  • National
  • Sports
  • Lifestyle
  • Travel
  • Opinion

© 2023 PeriscopeNGA.com - Periscope Nigeria | Website by Sociopact.

Jojobet GirişGrandpashabetgrandpashabetjojobetcasibom girişcasibomnakitbahisJojobetjojobetcasibomholiganbetjojobet girişbetcio girişbetcio girişjojobet girişcasibomJojobet