Dem tok sey time na money
Me, I no sure sey dat one na true
Because if time don go, e don go be dat.
You no go even see im brake light.
But if na money you dey talk,
alat still fit enter, as e enter Job account
You fit save your money for inside bank
make e dey grow small small like plant.
But if na time we dey tok, if e go,
e don go be dat
If time na money,
you tink sey big man go die of old age?
If time na money,
why King Solomon life no appreciate?
If time na money,
why money no be time?
Dem tok sey time na money
Me, I no sure sey dat one na true.
No be everybody wey fit give you money
deserve your time.
No let dem do 419 for you
***
Slang of the Week: One Chance
MEANING: When you enter a bad situation with no means of escaping
ETYMOLOGY: Used by Nigerians to describe a type of robbery (cases where an unsuspecting victim enters a vehicle of robbers, who strip them of their possessions)
USAGE: “Na after I open the packet see fufu instead of phone, na im I know sey I don enter one chance!”
Thought of the Week
“You no fit scratch body de wey wey body dey scratch you. If you do am so, blood go commot.”



