Tuesday, June 30, 2026
  • Home
  • Politics
  • News
  • Business
  • Culture
  • National
  • Sports
  • Lifestyle
  • Travel
  • Opinion
PeriscopeNGA.com
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Culture
  • Opinion
  • Lifestyle
  • Contact
No Result
View All Result
PeriscopeNGA.com
Home Opinion

For dis obodoyibo, by Ejalonibu

Harrison Willie by Harrison Willie
November 2, 2024
in Opinion, Opinion/Letter
4
For dis obodoyibo, by Ejalonibu

Pidgin poetry

1k
VIEWS
Share on FacebookShare on Twitter

 

For dis obodoyibo, 
dem nor dey yarn well well.
Na only “yes” or “no” dem
dey talk

Related posts

The second half advantage: Finishing strong through purpose, impact and legacy, by Cliff Stanley 

The second half advantage: Finishing strong through purpose, impact and legacy, by Cliff Stanley 

June 29, 2026
1k
The travails of a legal icon: The Mike Ozekhome story, by Erasmus Ikhide

The travails of a legal icon: The Mike Ozekhome story, by Erasmus Ikhide

June 29, 2026
1k

For Naija, if you ask us
weda we don chop.
Instead of to talk “yes”
we go sey:
“Why I nor go chop?
You cook egufe wey
carry bearbear like alpha,
you dey ask me weda I go chop.
Kuku talk sey because I no
get bearbear I no fit chop egufe.
Kuku talk sey you
nor like me.”

Pidgin poetry

For Naija, we no dey talk “no”.
Instead, my papa go sey
“Kuku kee me!”
My mama go sey “yes, shebi
Na coconut you carry dey
Call am head”

When I ask mama where make I drop
wetin she send me,
She go say
“Put am for my head”

For Naija, we get style
for everything we dey yarn.
If person ask how body,
we nor go just sey “fine.”
We go add, “Wetin man go do?
Body dey inside cloth.”

If rain fall and e soak person,
instead make we talk sey we cold,
we go sey, “Cold wan finish me.
If I catch dat rain, I go beat am
like pikin wey chop cane.”

If you see pregnant woman,
You no go talk sey she pregnant,
You go talk sey she chop
beleful.

Na so we dey talk for Naija,
our talk nor dey straight like line,
e dey bend, e dey twist,
like road wey dey Otukpo village.

For Naija, story full ground,
words nor dey scarce,
and question and answer
dey follow dia sef dance.

Tags: by EjalonibuFor dis obodoyibo
Previous Post

Underage children not spared from T-Pain’s wickedness – Atiku

Next Post

AGILE to construct 32 schools, empower girl child in Adamawa

Next Post
AGILE to construct 32 schools, empower girl child in Adamawa

AGILE to construct 32 schools, empower girl child in Adamawa

Comments 4

  1. drover sointeru says:
    2 years ago

    You made some decent points there. I looked on the internet for the issue and found most individuals will approve with your site.

  2. ayuda TFM arquitectura says:
    2 years ago

    Real superb visual appeal on this web site, I’d value it 10 10.

  3. Mixed Cannabinoid Gummies says:
    2 years ago

    I went over this internet site and I conceive you have a lot of wonderful information, saved to my bookmarks (:.

  4. portal liputan online says:
    2 years ago

    I like this website very much, Its a very nice post to read and get info . “Practice, the master of all things.” by Augustus Octavius.

BROWSE BY CATEGORIES

  • Advertorial
  • Agriculture
  • Appointment
  • Business
  • Columns
  • Covid-19
  • Crime
  • Culture
  • Development
  • Education
  • Family Planning
  • Features
  • Finding Purpose with Oluwatimileyin
  • Health
  • Interview
  • Investigation
  • Keeping It Real With Nneka
  • Lifestyle
  • Malnutrition
  • National
  • News
  • News
  • NYSC
  • Opinion
  • Opinion/Letter
  • Pillow Talks With Keziah
  • Politics
  • Responsible Parenting with Oluwatobi Akintola
  • Sport
  • Sports
  • Technology
  • Travel
  • Water, Sanitation and Hygiene

BROWSE BY TOPICS

#Gombe 000 2022 2023 2027 Abia Abuja Adamawa Again Apc Bauchi by Austen Akhagbeme by Ben Ngwakwe by Citizen Bolaji O. Akinyemi By Douglas Ogbankwa by Erasmus Ikhide by Hassan Gimba by Tony Erha Campaign CBN Commissioner Edo 2024 ekiti state FG Gombe Gombe Gov Gombe State Gov Yahaya Group Inec insecurity Kaltungo Mailantarki nigeria NNPP North-East NYSC others Pdp Police Qatar Taraba Tinubu USAID women
  • About
  • Advertise
  • Careers
  • Contact

© 2023 PeriscopeNGA.com - Periscope Nigeria | Website by Sociopact.

No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • News
  • Business
  • Culture
  • National
  • Sports
  • Lifestyle
  • Travel
  • Opinion

© 2023 PeriscopeNGA.com - Periscope Nigeria | Website by Sociopact.

Loading Comments...

    Jojobet GirişGrandpashabetgrandpashabetcasibomcasibom girişcasibomnakitbahisJojobetjojobetcasibomholiganbetjojobet girişbetcio girişbetcio girişjojobet girişcasibomJojobet