Big man dey travel,
Poor man dey japa.
Dia two nor be de same de same.
Cock-a-doodle-doo and
Kookoorookoo na de same?
E get reason why japa
rhyme well well wit sapa.
E get reason why travel and japa
no rhyme at all at all.
Make I explain:
Go Abuja go see house
for Asokoro.
Go Banana island go see where
dem dey use helicopter
carry pikin go school for Lekki.
For dis same our country,
people dey wey na
oyinbo wey get restaurant for America
dey come make eba for dem.
My oga pikin no dey find visa,
na visa dey find am.
Go look im Instagram,
see all de country wey hin don go.
Dem dey beg my oga wife make e take
passport for Dominica,
she say she no want, on top
sey she get Amerika own.
Na Nigeria big man like pass
for dis world.
But na de same Nigeria poor man
dey japa from.
Wetin make Mama Bonboy
enter canoe wit two children
sey she dey go Europe?
Wetin make Bros Jay
go dey trek for Sahara dessert?
Wetin make dia two talk sey
if dem die, dem die?
And all of dem die,
dia pikin join.
Na why I say na big man dey travel,
Poor man dey japa.
Dia two nor be de same de same.



